'I dey fear to look mirror say fine girl like me don turn to anoda thing'

Violet

Wia dis foto come from, Violet/BBC

Wen dem born Violet, she no get any deformity and she dey grow up, she sef dey like di woman she dey grow up into.

Dis one fit be why she dey shock and in disblief wen life suddenly change as dem diagnose say she get one disease wey no get cure.

Now, 27, Violet dey suffer from one rare health condition wey dem dey call Sclerodema.

Sclerodema na one kain disease wey also dey known as systemic sclerosis, na group of rare diseases wey involve di hardening and tightening of di skin. E dey too affect women more dan men.

E no get cure but treatments fit ease symptoms, slow progression and improve quality of life.

How e take start

Wetin we call dis Video, 'I dey fear to look mirror say fine girl like me don turn to anoda thing'

Violet siddon with BBC Pidgin as her parent watch on inside dia living room for di surburb of Delta state, south-south Nigeria.

She remember how everything about di moment wen things change for her.

Di young lady bin just dey finish her National Diploma for di Delta state polytechnic and dey think of wia to do her intership wen life strike her one blow.

She first notice one dark spot for her back,den her hands begin dey dark and dem become black well well. But, wetin she no know den be say, di dark spot na di beginning of di condition wey she go later learn say no get cure.

'I just round up my National Diploma dat time for Delta state Polytechnic I just finish ND na im e take start. E Just start with some kain dark spot for my back and this my hand dark well well. Very black.'' Violet tok.

As di disease dey grow for her body na so Violet phyiscal appearence dey change so tey she no too dey like wetin she dey become.

'I feel depressed.' She tok.

'To even look mirror sometimes I go dey fear say fine girl like me I don change to another thing but as times come dey go on I come get to accept and love myself di way I dey.''

I feel depressed I no fit dey go out. I no fit dey do wetin I suppose dey do. Me wey be say I tok say I wan be model. I dey inside di house. I no fit do anything. School dey on hold since. I feel depressed.'' Di 27 year-old further tok.

'Doctor say e no get cure, but I believe say I go well one day'

Violet

Violet and parent begin dey carry waka go everywhere for di hope say dem go see solution but things no be as dem dem hope.

From hospital to herbal centre to trado-medical homes, no one fit tell dem wetin dey happun to her and how she go get well.

''We don go many places for solutions. We go different hospitals. Di first time dem no even dey see anything. All di hospital wey we go, dem go say dem no see anything, even herbal centre, some go say na wound, some go say may be I match poison. Some go say na juju. Some go say na family problem and all dat.'' She reveal.

After plenti waka, Violet now don dey collect treatment for Delta state hospital.

''But now sha, we don dey take treatment for Delta State hospital, where I take dey see dermatologist.''

Even though doctor tell Violet and her parent say her condition no get cure, she still believe say one dey she go dey alright and she dey really hold on to dat belief.

''Di doctor say di sickness e no get cure but me I no believe for myself say e no get cute becos I believe say I go well one day.'' She tok wit hope.

'Family na everything'

While she dey tok about how she dey cope with di condition especially for di society, Violet dey quick to praise her papa and mama for dia support.

She say if no be for dem, evritin for dey somehow for her.

''Dem say Family na everything. My family don dey dia for me especially my papa and mama. Na only God fit bless those two for me.'' She tok.

She recall how her friends no dey believe say no dey well before hrer condition come show well-well for her body.

Infact, plenti pipo dey mock am but she no mind.

 ''Some pipo actually dey mock me with words, you know how friends dey be. E get back back words wey dem go dey tok make e no be say I wan contaminate dem. Some dey feel say I dey pretend because at first e no first dey, show dem go say na only sick I dey sick, I  dey pretend say I no well, but everything don clear before dem believe say I no really dey strong.

'Pipo say I dey inspire dem'

Violet don take her lemon to make lemonde as di popular saying go.

She na popular face for TikTok now and dey always use her page to motivate and inspire pipo.

Although, e get some pipo wey dey troll her but odas still dey wey she say love her ''genuinely''.

''My followers for tiktok, many of dem dey mock me but e get some wey be say dem love me genuinely and dem dey show love and care for me. For dat space I don see pipo wey be say love me pass some pipo for my family.''

''Many pipo dey come my DM dey tell me say I be inspiration. Some go even come ask say wetin be di secret of my life wen e be say all of a sudden me wey no fit dey stand up dey waka, I don wey waka now. Say I be very big inspiration for dem I thank God say e put me in charge of inspiration as pipo dey look up to me for inspiration.'' She add join.

Wetin to know about Scleroderma

Scleroderma (sklair-oh-DUR-muh), also known as systemic sclerosis, na group of rare diseases wey dey make skin hard and tight. E also fit cause problems for di blood vessels, internal organs and digestive tract.

Scleroderma dey often categorized as "limited" or "diffuse," wey refer only to di degree of skin involvement. Both types fit involve any of di other vascular or organ problems. Localized scleroderma, wey also dey known as morphea, dey affect only di skin.

While cure no dey for scleroderma, sabi pipo say treatments fit ease symptoms, slow progression and improve quality of life.

Anyone fit get scleroderma, but e dey occur much more often in women dan in men. Several combined factors appear to influence di risk of developing scleroderma